SHINE YOUR LIGHT voiced by: sound effects free download

By grazef6pidgin

10 Downloads

7 months ago

89 seconds

grazef6pidgin Sound Effects

About SHINE YOUR LIGHT voiced by: Mp3 Sound Effect

SHINE YOUR LIGHT voiced by: @Thekingswoman Some people get this bad habit of reducing their shine or reducing wetin dem fit do so that dem no go offend other people, or so that people no go say dem get pride. I don see people like that, even me I be like that before. Then one day I ask myself, "if this people sabi do wetin you fit do, dem go dey hide am, or them go show am make people see say dem sabi?" I think am well, and the answer na say dem go show am... Then I ask myself again, "So why you dey reduce your ability, on behalf of another man, just so you and dem go dey same level? and why you dey feel bad because you sabi do well for gift wey GOD give you?" The thing look funny, but many people get this habit. E fit even be say you get am too. You need stop am. For Matthew 5:14 - 16, Jesus say, “You be light of the world. Town wey dey hill no fit hide. People wey on lamp no dey hide am for bowl. Them go put am for table make house shine. So like that, let your light shine, make people see good wey you fit do, so that dem go fit Praise and worship BABA GOD because of you. " LET YOUR LIGHT SHINE. NO HIDE YOUR DOINGS. E FULL YOUR BODY, SHOW AM, GROW, MAKE THE WORLD KNOW SAY GOD DEY CARRY YOU. Believe Baba GOD and Believe yourself. #GOD #grazef6pidgin #motivation #inspiration #grazef6 #pidginenglish #pidgin #dailymotivation #nigeria
SHINE YOUR LIGHT Voiced By: Sound Effects Free Download. Sound Effects Downloader To Help You Download The Highest Quality SHINE YOUR LIGHT Voiced By: Sound Effects Free Download For TikTok Videos. You Just Search Sound Effects And Download.

My You Like It